LYRICS: Erigga – “The End”

[LYRICS]

 

Omo T A odo ba lighter I beg
Before the album come manage this one I no strong o
I beg I tire mehn
Time now na 2am I surpose to dey sleep u understand
Things full my head my wife dey bed na she dey shout
Oya Ajuwe wan talk media shut up
The line when I draw nobody fit clean am lock up
Wettin dey sup na too much cocaina
We no be blood na dis guy na Ribena
The loyalty of a broke man fit full four cup
Give dem garri keep watch if dem no steal four cup
Small Ciga money enter you Benson sweet
Dey chichi people help you when you no get chin
Wizzy really talk am no dey give man pass
Wettin e deserve ungrateful na fool here pass
No need to hug me Oko shake hand make you go
We no dey quarrel the prayer na make we blow
Some times e no bad if you remind your self
Say you be king no be only you crown your self
Nobody know them before na you put dem on
Me taroh shue oyote the game still on I n
Final whistle never blow the game still on
Na you go loose gad drop pad your game still on
Young kings secure bag the game still On
Who no loyal go riaja ekume me ta ro shew
Your girl when dey give me big head Oziegbe
But no I like give una gbe gbe gbe
Make una know this industry don buy gbege
Walls no be human being but them get ear
Before you spoil me give person observe am well
E fit go be my OG you know say lekki small
Wettin them talk for Chevron we hear am for phase 1
Can you imagine okro wan pass grow owner
No need for cutlass na hand take dey cut una
Life na bitch see the way dem dey fuck una
Money don finish see the way dem lock up una
Come block una and we know how much them chop una
Una hand dey hot why media no go rush una
The biggest scam na top ten street dey watch una
We know who suppose dey there make dem knock una
All this things them dey do dem me too
But I blow different between me and you
We no be mate like past tense of old you new
Na soap dem give you take baff you know wettin we chew
Career when die God raise like Lazarus
If no be social media dem for don cancel us
I dey my backyard spot dey smoke my big big kpef
I busy pass Ashawo curtain talk to don Kess
No limit quench the beat I wan make dem hear me well
Wear your nose mask nowadays yeye dey smell
To all my real gs when be say see money
Put your hands for your chest repeat after me
Who get pass me that one no be business
I no wish you bad Jehovah na my witness
I dey awake na God dey watch my tower
Fuck with my bag na open magazine towa
If media tell you say bad na lie I wicked
Dem say na small crase na lie oh I naked
For this industry we know who don touch money
Within ourselves so Aunty no form for me
California yourself which one you Philadelphia
Na all of us na im Corona hold oo

READ MORE:  LYRICS: Asake - "Yan Yan”
Show More
Back to top button